Tuesday, March 10, 2009

The naija pledge as a pikin take see am!©







Dem say make I throwey salute to my country,Naija.

But I begin wonda how I go be faithful,loyal&honest?
As the power to serve naija with all my strength don fail me.

I no see road ,

I no see clothe,

I no see food

I no even see light.

My papa no get money send me go school

He say dem never pay am grati...

whether na community money.

I no know sef .

I just know say 'ity' dey am yet no immunity against this kain suffer suffer

Even my school sef na ground we dey siddon
Abeg make una tell me,
where the power to uphold her honour and glory dey?

I no see am o
because as I never chop beleful arrange well for body.

The thing hard me o

But sha,no shakement.
E go better.
MAke God helep me.
Amen.






Awemoreborelanlay!
©27022009.

No comments: